HOUSEMATE WEY BIGGIE GO COMOT DIS SUNDAY WEY BE 2 AUGUST
Today, na 18 housemates wey biggie don put up for eviction as in introduce new twist for d game.
You know say voting don even close for d housemate wey dey up for eviction dis week inside d big brother naija house. And e come be say na only 2 housemate wey no dey for eviction and na lucy wey come b head of house and prince be in deputy.
Housemate wey dey up for eviction na
- Ozoemena Chukwu AKA Ozo
- Victoria Adeyele AKA Vee
- Boluwatife Aderogba AKA Lilo
- Timmy Sinclair AKA Trikytee
- Terseer Kiddwaya
- Dorathy Bachor
- Praise Nelson
- Florence Wathoni Anyansi
- Tochukwu Okechukwu AKA Tochi
- Kate Jones AKA Ka3na
- Eric Akhigbe
- Ngozi Nlewedim AKA Erica
- Ezekiel Bright Osemudiame AKA Brighto
- Aisha Umaru AKA Kaisha
- Emuobonuvie Akpofure AKA Neo
- Tolani Shobajo AKA Tolanibaj
- Olamilekan Agbeleshe AKA Laycon
- Rebecca Hampson AKA Nengi
Depending on wetin be di outcome of di votes na some of di housemates wey get di least vote go comot from di house.
How di Live Eviction go dey dis season?
Every Sunday di housemates go take part for di live eviction.
Each housemate go get dia time to nominate one of di bottom four housemates wey get di lowest votes from di public inside di eviction room
Di Housemates wey get di highest votes from dia fellow housemates na im dem go evict from di bb naija house.
Dis na di first time wey biggie dey introduce am for di season 5 big brother naija lockdown.
This week na him dey start dat one oo
Correct Yarn..
ReplyDeleteYes oo make u just dey in touch with the blog
ReplyDelete