Skip to main content

2020 Police Recruitment Exercise don Start

IGP Mohammed Adamu

2020 Police recruitment exercise don start.


Nigeria Police Force (NPF) don announce say dem don begin dia 2020 recruitment for people  and dem  dey invite pipo wey qualify to apply.

Police tok pesin, Frank Mba, say applicants must dey between di age of 17 to 25 years and must get " minimum of five credits, including English and Mathematics, for their WASSCE/NECO/GCE/NABTEB.


E tok say di application go dey open for six weeks from now  to 23rd August, 2020 and dem no dey pay money for application

How to apply for di 2020 police job

  • You must get email address wey still dey work and National identification number(NIN) before you begin your application.
  • Wen you go the website, you go fill and submit di online form (make sure say you look di information well-well before you submit finally).
  • You must also make sure say you print di information wey di computer send automatically to your email and no forget to copy and save your registration number for future purpose.
  • You no fit use one particular email or NIN more than once for di application
  • If you pass enta di next stage, you go need to present di hardcopy of di email message wey you receive if you pass enta di next stage of di recruitment.

  • Pipo wey Police tok say dem qualify to apply

Persin wey wan apply must get passion to do police work and must get dis requirement;

  • You must be Nigerian by birth and get National Identity Number (NIN)
  • You must get minimum of 5 credit for not more than 2 sittings for WASSCE/GCE/NECONABTEB with credit pass for English and Mathematics
  • You must dey between di age of 17 -25 years
  • You must dey medically, physically and psychologically fit and must not be less than 1.67m tall for male and 1.64m tall for female.
  • You must also no get less than 86cm (34 inches) expanded chest measurement (for men only)
  • If you be woman and you wan apply, make sure say you no dey pregnant for di time of recruitment.
  • You must also dey free from any kind of money embarrassment
  • You must print your completed online form, guarantor forms and submit all of dem for di examination/screening and recruitment centres.
IGP Mohammed Adamu
Wetin we call dis foto, 

IGP Mohammed Adamu

Oga Frank Mba say dem go call applicants wey meet di requirements from di online registration for physical screening for all di state commands, including FCT Command, from 24th August 2020 to 30th August 2020

Pipo wey no dey allowed to apply

  • Na Pesin wey get speech palava
  • Pesin wey get serious teeth or jaw problem sotey e no fit chop well
  • Knock knees
  • Bow legs
  • Bent knees- dat na knees wey no fit straight if di pesin stand attention
  • Deform hand wey no fit perform di full function of di hand
  • Bad eyesight or squints eyes (dat na half past eyes)
  • Amputation for any part of di body.




Comments