Nigeria Airforce first female combat helicopter pilot Tolulope Arotile don die
on
Get link
Facebook
X
Pinterest
Email
Other Apps
Nigeria Airforce first female combat helicopter pilot Tolulope Arotile don die
WIA DIS FOTO COME FROM, NIGERIAN AIRFORCE/TWITTER
Wetin we call dis foto,
Flying Airforce Tolulope Arotile
Nigerian first ever female combat helicopter pilot for di Nigerian Air Force Tolulope Arotile don die.
Di Nigerian Air Force announce am for dia twitter account say di young flying officer die from di head injury wey she get from di road accident wey happun for NAF base
Flying officer Tolulope Arotile die on 14 July 2020 according to di Nigerian Air Force wey announce her death.
WIA DIS FOTO COME FROM, NIGERIAN AIR FORCE
Di Nigerian Airforce commission Arotile into Nigeria Air Force for September 2017 as a member of di Nigerian Defence Academy Regular Course 64 and which make her to be the first ever female combat helicopter for di service.
During her short stay for service, di Nigerian Air Force tok say late Arotile contribute well to destroy armed bandits wey dey di North Central States and other criminal elements by flying several combat missions under Operation GAMA AIKI in Minna, Niger State.
This one na anoda big loss to Nigerian Airforce make her soul Rest In Peace.
Comments
Post a Comment