Microsoft wan buy TikTok afta Trump announce say e go ban the company/app to dey operate for US
Baba for Tech, Microsoft don announce say dem go buy d social media app, TikTok afta US President Donald Trump tok day e go ban the app from US say cause say Chinese gone to dey use d app dey pip Americans.
Microsoft tok say dia over all Oga Satya Nadella talk with Trump make e buy the app, from d Chinese company ByteDance afta US law makers dey worried because say d app get ability to invade users privacy.
"[Microsoft] dey ready to buy TikTok which means say dem go do complete security review and provide better economic benefits to di United States, plus di United States Treasury," dicompany tok, dem also tok say dem go move sharply to tok with ByteDance" in a matter of weeks."
" Microsoft go continue to dey wait for more discussions with di United States Goment, plus di President," di company tok.
Di new structure go build better experience for TikTok users currently love, den add world-class security, privacy, and digital safety protections," Microsoft said.
If Microsoft buy TikTok e go stop the ban wey Trump threaten on Friday July 31. Trump tok say, im fit use emergency economic powers or executive order to stop d app to work for United States.
If di deal get head, Microsoft go buy almost all d shares of Tiktok's parent company ByteDance, Microsoft go con own and operate TikTok services for US, Canada, Australia and New Zealand and go con make sure say all private info of all d American pipo wey dey use TikTok's go con dey to United States.
Comments
Post a Comment